WAEC QUESTION AND AKPOS ANSWER

WAEC examination,
Akpos was asked
to complete
thefollowing:
1) He who fights n
run away?
Akpos: e don
surrender be dat
na, na fear catch
am.?
2) A rolling stone?
Akpos: No fit just
dey roll, na person
push am.?
...3) He who lives in
a glass house?
Akpos: Na rich
politician e go be.?
4) A stitch in time?
Akpos: dey
prevent further
tear tear.?
5) Birds of d same
feather?
Akpos: Na d same
mama born them.?
6) One good turn?
Akpos: Na correct
power steering fit
do am.?
7) A bird in hand?
Akpos: Wetin e wan
be again if nobe
barbeque. Dem
plenty for chicken
republic.?
8) Half bread is
better than?
Akpos: Puff puff,
buns or garri
without sugar.?
9) A journey of a
thousand miles?
Akpos: Na d person
wahala be dat na,
Why e no enter car
or aeroplane jeje??
10) He who laughs
last?
Akpos: Get brain
problem. Make dem
examine am becos
na begining of
madness be dat.?
11) A patient dog?
Akpos: Na hunger
go kill am.?
12) All work and no
play?
Akpos: Na bank job
be dat bros.?
13) Once beaten?
Akpos: Naa
revenge go follow
b dat.?
14) A fool at forty?
Akpos: U never see
Naija own, ours
starts @ 50.?
15) A friend in
need?
Akpos: Na parasite
b dat.
(16) Slow and
steady... Akpos:
walahi na last u go
carry.

Comments

Keep up to date with our latest articles and uploads...